...

Psalms 23 in Pigin…

Posted On January 13, 2006 | Written by Emmanuel Oluwatosin

1. The Lord na my shephard, I dey kampe.

2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool.

3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Hin name.

4. Walahi !, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me.

5. You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank.

6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai.

GOD ALMIGHTY NA YOU BIKO

AMEN.

One Response

  1. I subscribed to the RSS feed for this blog and on seeing the headline “Psalms 23 in Pigin…” a few moments ago, I promptly clicked.

    Reading brought me some humour. I find the Nigerian version of pidgin english very funny.

    The spelling is “pidgin” though, not “pigin” as you put it. Its good all the same.

    Many thanks…

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

You May Also Like